Gbanjo! Gbanjo! Gbanjo! Everything wey hin do no dey prosper For di young, na agbako For di old, na thrice upon a time Gbanjo! Gbanjo! Gbanjo! Pikin dey ball Old ones dey yawn Wetin we go call am? Dem sey ‘e go beta, e go beta’ Where youth soldiers dey? Mey we go add plenty red For di white wey dey middle of greens Cause you revolt today, you die today U no revolt today, u go die tomorrow U fi go bed today, drop today U knack or u no knack, u fit die anytime This thing una dey call hope for Naija Na hope? Or na cope? Hoping for the best? Coping with the pest! Gbanjo! Gbanjo! Gbanjo! They eat and thin They drink and thirst What do they eat? What do they drink? If not their own suffering “Oya mey we fight the struggle” Settle and level evri ting sharp sharp Wetin our people go sey? Dem go sey “mey God jus bless our hustle jare” Abeg, wetin be “bless hustle” wen peace no dey for awa land Dis one wey poverty no gree pack load komot awa mist Who go fit arrest poverty? Police sef don give us handcuffs sey mey we helep dem Politicians nko? Dem sey na d wok of police o Gbanjo! Gbanjo! Gbanjo! Naija is not for sale Naija is for display The evidence of minds behind bars.
©️Gbọ́láhàn Adébíyì
Thank you for taking the time to read it!
The poem was written in April 2022 and this is the first time it is going public. You are one of the first set of readers reading it. Don’t forget to subscribe if you don’t want to miss my next post. :)